[Story] ADANNA; The Mysterious Aba girl. Season 1 Episode 1
ADANNA THE MYSTERIOUS ABA GIRL, SHE CAME LIKE A GHOST AND
VANISH LIKE A WIND
True Life Story
Episode 1
Enjoying my sleep in the evening around 8pm on saturday, na
10pm i dey take sleep before but since no food to chop i gat to sleep and put
the groaning worm in my stomach at rest, i havent slept 30 minutes wen my phone
rang, i check the caller na blessing.
Me: baby whatsup
blessing: i don tell you make you nor dey call me baby
again, where you dey?
me: i dey my house na where you expect make i dey before?
blessing: your girlfriend house na.
Me: i don tell you na only you be the girl wey i get.
Blessing: na who be your girl, let my guy catch you, your
own don finish be that, abeg i don buy that laptop come help me check am weda
na better one and to configure am for me abeg.
Me: abeg make am tommorow i dey tire and i wan sleep.
Blessing: abeg na i nor fit watch film for inside self and i
need to keep myself busy.
Me: call your boyfriend na
blessing: i don tell you my guy no dey leave here.
Me: na who come dey sample u na?
Blessing: sample what?
Me: sorry nothing.
Blessing: e better be nothing rotten mind, by the way i cook
rice.
Me: am on my way.
Blessing na my coursemate for one polytechnic wey dey MCC
aba, i don try chike the babe many times, but the babe dey form strong head for
me, but since she want something from me then i must get something in return
apart from the rice, we must balance the equation, afterall one great man say,
“For every action, there is an equal and opposite reaction”. There must be an
opposite reaction today oh.
ingredient nor dey dey her food but the food dey sweet well,
she is dark in complexion not too tall, her behind not too big and not too
small, her b----t is average also, as for me am fair, hairy and tall.
I put on my clothes and took my phone and my earpiece why i
head to her place, her house far small sha but i gat no choice, i must consume
that rice oh, i check the time 8:45pm, everywhere is dark nobody dey road, e be
say people quick enter house today oh, maybe na the wether cause sha,
i was walking slowly enjoying the music booming from my
earphone like tecno Boom J7 when someone flash light from behind, i removed the
earpiece i heard a lady voice from my back calling my name “ozilla” i turn back
i saw nobody, na who come call my name na, e be like say the hungry don dey
make me hear different things, i pocket my phone and continue moving i fasten
my footstep, half way to her place i heard the voice again, a slick tender
voice from my back, “why are you moving fast” i look back again i saw nobody,
oboy na which kind thing be this na, i run oh because this time i heard it
clearly, i ran as fast as i can till i get to blessing house. i didnt hear her
till i reach her house, she live in a fence house but no gate, her room was
build separately beside the main building just like a store, one room.
I knock on her door, she didnt answer, i knock again and i
heard ” who is that”
Me: idiot na me open the door.
She open the door and i enter and i quickly closed the door.
Blessing: wetin happen why u dey sweat like hegoat.
Me: u nor go understand.
Me: abeg give me water first, before i quench.
Blessing: tell me wetin happen wey you dey sweat like this,
na dog pursue you?
No be only dog, this one worse pass dog, e for better if na
dog, but dog no dey talk na, she gave me water, i look around no sign of any
cooked food.
Me: wey the food wey you say you cook?
Blessing: abeg no vex i know say u nor go come thats why i
use the food draw you.
Me: please tell me you are joking.
Blessing: am not and am sorry.
Me: you mean say all this suffer wey i don suffer for road
all na for nothing,
Blessing: no vex na abeg i just want you to help me with my
laptop.
Chai awish no be girl i swear i for slap her, I was very
angry, i stood up, go to the door and wanted to leave, she stood up quickly and
block the door.
Me: let me dey go abeg.
Blessing: why you dey quick vex like this na.
Me: if you know the kind thing wey happen for road you nor
go talk like this.
Blessing: na wetin go happen wey you go come leave without
eveing seeing the laptop.
Me: that one no concern me again, i need something to quench
the worm disturbing my stomach.
I wanted to move her away from the door so that i will pass,
she hold the hand and put it on her chicks, looking at me in a seductive way, i
rub her chick with my hand while she bite her lips in a seductively, she wore
red legins with a handless shirt, she put her two hands around my neck, draw my
head closer and gave me a sweet kisss, waoh i was flabbergasted, girl wey i don
dey try to chike since come dey give me free kiss, omo i gat to grab the
opportunity.
I return the kiss and press her against the door, i press
her b----t and she moan a little, i removed her shirt and move her bra one side
and kiss her sweet b----t, she moan again, i lose her bra and bury my face in
her b----t as she use her right leg to draw my body closer to her.
No comments